Open pidgin letter from a poor man to GEJ (Must Read) | This Is Miss Petite Nigeria Blog

Saturday 19 April 2014

Open pidgin letter from a poor man to GEJ (Must Read)

Dear Mr. President, I just want beg you Bros Jonathan. I take all the gods of Nigeria beg you. I take all the gods wey people dey hide worship beg you. I take the God wey most of us dey worship openly beg you. I take the day wey dem born you take beg you. I take all the things wey you like beg you. Bros, as I dey write this ehn, na prostrate I prostrate for you oh. I take all my heart beg you. I take my papa yam farm beg you. I use my papa cocoa plantation beg you.

I take Anti Party take beg you. Shey na 2015? No worry we go dash you till 2019. Missing $20 billion? No be craze de worry Sanusi Lamido, where him see that kind money dey miss, no mind am Bros, we don comot our mind for that one too. We no even want know how you take dey spend oil subsidy money Bros. Spend am anyhow, na you be Presido. Even the almost one trillion naira for security sef, we don close our eyes. Bros, if you like no do any road again, we no go ask you. Fuel scarcity?? No worry Bros, e don tey wey we don dey use to am.



We sabi buy black market. Abi people wey dey sell am dey from there get dem own chop no be we brothers? Bros, even jobs sef, no worry your head for that one. Na you send people make dem born plenty children? No worry, we sabi struggle. Electricity? Forget dat one Bros J. How many of we grand papas use electricity? Dem no live long? We go dey manage dat one too. If we want enjoy, we go use our Gencos. Thank God say we never follow your advice say make we throw dem away. Bros J., all these my begging ehn, na one thing I need from you.

This one wey Nigerians life no come even get value reach cockroach for oyinbo land own tire me. Bros, just use all your head and mind dey see how you go take dey protect our life. We no need all those things wey we dey disturb you for. Na long throat dey do us. Just help us make we dey safe Bros. If you fit do that one for us ehn, I go join curse anybody wey ask you how you take dey spend we money. We no want to dey waka dey fear say the next sound fit be bomb sound Bros.

We no want to dey see fellow struggling Nigerians dey roast like chickens wey oyinbo say dem get bird flu. Bros J, sebi you talk say you no get shoe? E mean say you too be one of us before before. If dem former leaders no protect you allow bomb finish you, se you for reach where you dey so so tey you no fit know how many shoes you get. God wey carry you reach there never resign oh and na Him I dey take beg you make you do everything to see say we too live oh. I beg Bros J., no mind all these people wey say you no go continue.

Just protect our life for us. Na your hand soldiers, police and all of them dey. Use them protect we the poor masses too na. No be only the big big men and women deserve to live safe. We too, na life dey our body and wetin fit make wey una dey where una dey so, we too fit reach there oh one day. But, that one na only if we live. I take God beg you Bros J., na beg I dey beg, no be strong head.

Greet mama peace,abi wetin dem call am,for me!

(Source :Hauwa Oshafu's FB)

32 comments:

  1. Yes oh, e reach to beg,because the way people dey die these days don too much,I no go blame the person wey dey always comment "End times " for here because e really be like endtimes for naija,no week dey pass wey we no dey hear about masive killings for dis our country,abeg Uncle Jona,na everything we use dey. Beg you,we need security,if possible,go contact Jack Bauer and the entire CTU,make them. Come help us fight this terrorists

    ReplyDelete
    Replies
    1. Begging is the only way, as shouting isn't working

      Delete
  2. Very touching poor man writting

    ReplyDelete
    Replies
    1. naijabp.com said: indeed very touching

      Delete
    2. Awwww...I hope Mr President gets to read this and acts on it.
      7 Ways To Learn To Love Yourself Unconditionally- click my name to read more

      Delete
  3. Sadly the truth and nice way to point out his poor leadership skills!

    ReplyDelete
  4. I tell you. All we need now is security, let him forget about every other thing. What is the use of amenities if you won't be alive to enjoy them

    ReplyDelete
  5. Please can someone translate this letter. I don't understand nor read pidgin. I grew up in Whales England and speak the Queens English. Translate and win 100 naira airtime of your choice

    ReplyDelete
    Replies
    1. Abi o Truth i cant read pidgin but do u knw u re very foolish? Am sure u dnt knw wen u wia born

      *CUTEMICKY*

      Delete
    2. Mumu it's Wales! And they have a Welsh language too. Fuck off!

      Delete
    3. This comment has been removed by the author.

      Delete
    4. Na you be first person to live for Wales from 9nja? Make I no insult you.Maga!

      Delete
    5. Na Wales you belong. SO, wetin concern 9nja Concern you? Just tay quiet!

      Delete
    6. Lol @ WHALES, WHALES indeed, I bet you grew up in SHARKS too. Lmao.

      Delete
    7. hehehe! you pple here won't kill me with laughter! you guys just cracked me up! just peed on myself! God bless you guys for making me laugh soooooooooooo hard.

      Delete
  6. I just wish my able presido go put head for ground make him really see wetin we nigerians dey pass through on a daily basis, but no, bros jonah just dey jolly for party they feel like one kind baddoo.... Shah ur time don den quench, come do comot abeg.......
    .
    .
    .
    ***CURRENTLY IN JUPITER***

    ReplyDelete
  7. Plea for life.. Found ds amusing but it sure makes sense

    ReplyDelete
  8. Stupid writer. Not funny. The mentality that shows we don't know our rights or ever want to move forward

    ReplyDelete
    Replies
    1. What do you mean? what have you done with the rights you claim to know? E reach time to beg them. Na wetin dey up be that/.

      Delete
  9. no bi lie writer u make sense no bi small i follow join beg oga jONA ,make im help us 4 security mata first cos na who dey safe dey tink of other basic amenities of life.the missing money no concern me too.na God i take beg u oga JONA.

    ReplyDelete
  10. Itz well wif us....God bless 9ja
    •••LAG BOI•••

    ReplyDelete
  11. All we need is Peae in our country, let's come as one and leave in harmony! Nice one Ms Hauwa

    ReplyDelete
  12. This comment has been removed by the author.

    ReplyDelete
  13. I just love reading pidgin. I hope we had it in my country. It jst makes things easy, no breaking head with grammar.

    ReplyDelete
  14. Touching to read...
    Broken bottle"

    ReplyDelete
  15. Hmmmm! Dis mata no b 4 only Jonathan o, security na for everybody... e no easy o. Abeg na for us to pray no b to criticize oga joe

    ReplyDelete
  16. Makes sense.

    ReplyDelete
  17. YES!*security is paramount* God, pls intervene in the matters of Nigeria so that we'll stop dying like chickens! Only God can touch the heart of the president. Religious leaders and delegates who have access to the president should make him understand why we need God in this country. I trust Nigerians if we're told to fast again after this previous fasting we're willing to do but all without God touching the president's heart will be in vain.*i drop my keypads here* GOD!!!

    ReplyDelete
  18. dat is gud my dear

    ReplyDelete



For Inquiries/Tipoff emepretty@gmail.com - Call 08095369321